Wednesday, October 4, 2017

One big Oga don enter yawa

Di fight against corruption for Nigeria don reach another level for Tuesday 3rd October 2017. Dis na because one Federal High Court don jail one former government oga for 40 years because of corruption. Di court say Professor Adefemi Ogunbodede, wey be former Director-General for Institute of Agriculture Research and Training for Ibadan, Oyo State misuse 177 million Naira ($321,429). Na di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC), government agency wey dey in-charge of fight against corruption carry case go court come win.


SOURCE: BBC PIDGIN SERVICE




No comments: