Monday, December 28, 2009

See Wetin Farouk don Cause


Una see me see wahala o! Becos our person carry small gunpowder for plane to injure himself, all of us don become suspect. Una hear wetin happen recently? One of we people chop leaf for transatlantic flight na im e bele begin pain am. One hour to landing, bros still dey for toilet.


On dat note, dem take am as suspect, detain am, search am for some hours then eventually, release am. Na di problem we dey o! Na so e go bi for some time.


So my advice;

1. go on compulsory fasting before transatlantic flight

2. avoid all di medemede ingredients for baggage.

3. snuff is a no no

4. make una no sit down near wing

5. no use blanket cover ya body

6. make una no drink red wine and too much minerals

7. if you see dog, make you standa kampe.

8. make sure say piss time no pass 5 mins

9. wear jeans and t shirt

10. no look people eye too much


God go helep us o!
By Tosan Aduayi, Publisher, Trendy Africa. Trendy Africa is a Multi Media Production Company based in Texas and are Publishers of Trendy Africa Magazine, Trendy Africa Fashion Xtra and www.trendyafrica.comFor Inquiries, please call +1 817 538 2145

2 comments:

Kemi Omololu-Olunloyo said...

Tosan....Excellent

Kemi Omololu-Olunloyo said...

Na me again O!

I have a great solution:
1) have a section on the plane reserved for men only. No books, no blankets, no gadgets, no carry on.
2) have another section for ladies and children where we can fly like normal human beings with all the "extras".
Never heard of any lady doing anything this stupid - so why should we be punished??